Sie sind auf Seite 1von 2

YOU GO SURVIVE WHEN THE LAST DAYS END?

Wetin person wey go give this talk go do:


Make dem know sey time no dey again. For the end, help dem see sey na the last days we dey.
Make the talk touch their mind, so that dem go dey do wetin go make dem survive

WE NEED TO THINK ABOUT WHETHER WE GO SURVIVE THE LAST DAYS (2 min.)


Jehovah Witness people dey teach people for the whole world sey we dey the last days
Na true sey na last days we really dey? Anything show sey na last days we dey? Wetin we go do
to survive?
Jesus warn people for im time sey dem go soon destroy Jerusalem
We fit learn from people wey survive that time because dem know the things wey show sey dem
go soon destroy Jerusalem

JESUS TALK AM SEY DEM GO DESTROY JERUSALEM (7 min.)


Jesus warn people about the things wey go happen before dem go destroy Jerusalem [Read
Matthew 24:1-8]
E tell im disciple sey make dem run when dem see sey soldier don surround Jerusalem (Lu 21:
20-22; w15 7/15 14-15 ¶1-3)
People wey dey write things wey don happen show sey wetin Jesus talk really happen to
Jerusalem before the year 100 C.E (w07 4/1 8-11)
Cestius Gallus with im soldier first go Jerusalem for the year 66 C.E. come later go back,
this one give Jesus disciples the chance to run comot from Jerusalem (w12 4/15 25-26 ¶13-
15)
That time, the last days end when Rome soldiers go back go destroy Jerusalem for 70 C.E.
People wey hear when Jesus dey talk am that time see as everything take happen, and the disciples
wey do wetin e talk survive
Jesus still talk sey many people no go gree use their sense and dem go do strong head [Read
Luke 19:43, 44]

THINGS WEY BIBLE SEY GO DEY HAPPEN FOR THE LAST DAYS, DEY HAPPEN
FOR OUR TIME (7 min.)
Things wey don happen wey dem write show sey many things wey dey Matthew 24 first happen
from 33 C.E. to 70 C.E. (Mt 24:4-22)
Since 1914 wey God Kingdom start to dey rule for heaven, the things wey Jesus talk don dey
happen well well for the whole world (g 10/12 26-28)
Revelation chapter 6 show sey Jesus go become King the time when food no go plenty for this
earth, and when war and other wahala go dey (w14 1/15 28-29 ¶4-7)
Dem write the book of Revelation around 25 years after dem destroy Jerusalem
As e be sey wetin dey Matthew 24 and Revelation 6 gree with each other, e show sey wetin dey
Matthew 24 go still happen for front
So wetin don happen wey dem write and wetin Bible talk show sey wetin dey Matthew 24 still dey
happen for our time

OTHER THINGS WEY SHOW SEY NA ‘THE LAST DAYS’ WE DEY (6 min.)
For 2 Timothy 3:1-7, Bible still talk some things wey go dey happen for this last days [Read
verse 1]
Paul talk about the kind things wey go dey happen and the kind character wey people go get
[Explain 2 Timothy 3:2-5]
Paul no dey talk about the last day for Jerusalem (w94 4/15 10-11 ¶14-17; it-2 206 ¶6)
Paul dey talk about our time (w14 1/15 29-30 ¶8-13; w06 9/15 5-6)
So from wetin Bible talk, e dey clear sey for this our time, na the last days we dey

ANYBODY WEY WANT SURVIVE MUST DO WETIN GO SAVE AM (8 min.)


Even though sey e dey clear sey na the last days we dey, people wey no want hear dey plenty more
more, as e be for Jerusalem before dem destroy am for 70 C.E. (2Pe 3:3, 4)
E dey important sey make we serve God and do wetin e want to show sey we believe sey the last
days go soon end [Read 2 Peter 3:11, 12a]
Many people wey dey hear sey God go soon destroy this world need to dey change their life
Jehovah Witness people dey happy to study Bible with dem for free
For people wey don dey serve Jehovah, e no good make dem let anything for their life comot
their mind for Jehovah work (w06 12/15 18-19 ¶17-18)
Na now be the time for us to stand well for Jehovah side and do wetin go save us [Read 2 Peter 3:
14] (w10 7/15 9 ¶10-11)
[No comot from wetin this outline talk, come go dey talk another thing. Follow the time wey dey all
the part. You no need to read or talk about all the Bible verse. Check Ministry School book, page
52-55, 166-169]
No. 2-NGP 9/15 NA 30 MINUTE TALK BE THIS
© 2015 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania

Das könnte Ihnen auch gefallen